Jeje

See kpokpo enter house
See kpokpo enter house
Make una See kpokpo enter house
See kpokpo lock your gate

Shyboi
Watagwan
Watagwan
Ahh Watagwan

Tell me why people nor go cry
Tell me why people nor go die on time
Why people nor go share tears ahhh ahee

The police dem na them Dey kill us pass
SARS self they kill us pass
Tell me why them nor go use us starve
The Bang bang

Who be that make they knock for my door
Becoz if na police I go sh** for your head
If una get any thing to talk
make una talk am for the station way them
Give una

Festus alekhe they there
Commission of police they there
Oga at the top self them they there
Because I doubt if una go fit reach there

I just they try to hold me tears
Situation just don dey tear my shirt
Na peace protest and they kill’em there
Oct 20th we nor go forget (At all)

Our government just dey use us de play prawns
Them do us coning still de loot us from distance
Reformation reformation still no uniform
The leaders of tomorrow still de suffer from malnutrition
Na wa ooo

I don’t know I don’t know
Know why
Why them do this to us and go hyy
Say I don’t know I don’t know
Know why
Why them do this to us and go hyy

My fellow Nigerians
My follow Nigerians
Make una use una vote wisely
If you try to take bribe na God go punish you

Oya waiting una wan talk now
We go build road and we go build school
We go give una light till the end of the world
Before u go know you go hear share the rice
Comont for there Ajibole
We nor want rice we want Confort
Ahh police nor go let us rest
If you be boy and you fine omo na problem

Festus alekhe they there
Commission of police they there
Oga at the top self them they there
Because I doubt if una go fit reach there

Them say make I sell my vote for 5k
5k way nor fit buy plate of wanke
Wanke way I go flex I go shit off
Tell the politicians make them piss off awayyyy
Na my right and I go vote
Anybody step on my human right I swear I go oppose
Make them bring the G** na my mother land I’ve swore to defend
Anytime Arise o compatriot Nigeria me I stand

I don’t know I don’t know
Know why
Why them do this to us and go hyy
Say I don’t know I don’t know
Know why
Why them do this to us and go hyy

Who be that make they knock for my door
Becoz if na police I go sh** for your head
If una get any thing to talk to talk
make una talk am for the station way them
Give una

See kpokpo enter house
See kpokpo enter house
Make una See kpokpo enter house
See kpokpo lock your gate

Músicas más populares de Kudos

Otros artistas de House music