Say No to Rape

Valentine Chukwu

Story of a fine girl
Wey dey dress well well
I say she too sexy
She too flashy
She too gather

Abobi want to kiss her
And she no want am (Oh wey!)
No dey force am
Cos if you Rape her
You don kill am (Oh wey!)

Cos the pain no go go away
And her life will never be the same
No solution to depression
E go make her life to go astray

Brother make you use your head
If she say No, no dey try again
Cos if you press am, e go vex am
"No" means make you end the game

Shout out to the men wey sabi
Say No To Rape oh
We dey zip up with their conscience oh
Say No To Rape oh
Cos if she want am
She go put am oh
Say No To Rape oh
So make you no dey force am
No dey Rape her
Yeah yeah yeah

Músicas más populares de Iconic

Otros artistas de Hard rock