Heya! [Album]

Olawale Olofo'ro

Everybody say them dey go their way
But I notice say
Say we dey block each other way
Lai lai
You no go hear the people say
Say na our ignorance dey make life hard

Heya
Heya
Some dey talk and some dey walk
And time just dey pass us by

Every woman dey look for man wey go love her right
Wey go ignore her shortcomings
Wey go take her like that
And every man dey look for woman to hold tight
But na im ignorance dey let love down

Heya
Heya
Some dey come and some dey go
And love just dey pass us by

I don dey stubborn since the time I be small pikin
Na me dey always first see the problem
E ah e
Na me dey quit last
I no dey run fast
Papa say make I live freely
Like rich man pikin

Heya
Heya
I just dey fall I just dey rise
And time just dey pass me by

Heya
Heya
Some dey laugh and some dey cry
And time just dey pass us by
Some dey work and some dey pray
And time just dey pass us by

Curiosidades sobre la música Heya! [Album] del Brymo

¿Quién compuso la canción “Heya! [Album]” de Brymo?
La canción “Heya! [Album]” de Brymo fue compuesta por Olawale Olofo'ro.

Músicas más populares de Brymo

Otros artistas de